Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (2024)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (1)

Wia dis foto come from, Forbes

Na LVMH French luxury goods titan Bernard Arnault and im family be di richest man in di world wit estimated $233bn (£185bn).

For last year Forbes list, na only six pipo wey dia fortune pass $100 billion.

Wetin dey new be say dis year list, wey dem release on Tuesday (April 2), more dan double di number of members of dis exclusive club, wey now stand for 14.

To get idea of ​​di size of dat kain wealth, simply consider di gross domestic product (GDP) of one kontri, dat na to say di sum of all di goods and services wey dem produces for one year.

Sake of dis, di individual wealth of each of dis 14 tycoons big pass di GDP of kontris like Panama, Uruguay, Costa Rica or Bolivia.

Skip Recommended articles and continue reading

Recommended articles

End of Recommended articles

Chase Peterson-Withorn, di Forbes editor wey dey responsible for di list, tok say last year dey "incredible" for di world richest pipo.

“Even for times of financial uncertainty for many, di super-rich kontinu to do well,” e note.

Forbes tok say dem record 2,781 billionaires for 2024, 141 more dan di previous year and 26 more dan di previous record for 2021.

Dis big men dey rich pass ever and don gather wealth of 14.2 trillion US dollars.

For di lead, di moguls of di most exclusive club on di planet, according to Forbes

1. Bernard Arnault (France)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (2)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $233 billion

For di second year in a row, Oga Arnault na di richest pesin for di world.

Im fortune bin rise 10% for 2023 thanks to anoda year of record sales for im luxury conglomerate, LVMH, wey own Louis Vuitton, Christian Dior and Sephora.

2. Elon Musk (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (3)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $195 billion

Wit di ranking wey constantly dey change, Musk don win and lost di title of "richest for di world" several times, depending on di valuation of im companies, SpaceX, Tesla and di social network X (formerly Twitter).

3. Jeff Bezos (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (4)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $194 billion

Bezos bin get rich dis year thanks to Amazon excellent stock performance.

4. Mark Zuckerberg (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (5)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $177 billion

Meta CEO don see im own ups and downs. Afta shares of di social media giant fall 75% from dia highest level for 2021, dia value bin almost triple last year.

5. Larry Ellison (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (6)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $141 billion

For di past year, shares of technology company Oracle don rise more dan 30%, wey send dia fortunes up-up. Although e don step down as chairman of di company, Ellison kontinu to chair di board of directors, serve as di chief technical officer and be im largest shareholder.

6. Warren Buffett (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (7)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $133 billion

Dem consider am as one of di most successful investors of all time, na Buffett dey run Berkshire Hathaway, one conglomerate wey own dozens of companies, including di Geico insurance company, di battery maker Duracell and di Dairy Queen restaurant chain. Berkshire shares dey record highs, up 30% over di last year.

7. Bill Gates (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (8)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $128 billion

Di Microsoft co-founder bifor na di world richest pesin for 18 of di 23 years between 1995 and 2017. Despite im ogbonge fortune, Gates bin fall down di list sake of high competition for di technology sector, one divorce wey cost am dearly for 2021 and im donations to charity, according to Forbes.

8. Steve Ballmer (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (9)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $121 billion

Di former Microsoft president bin lead di company from 2000 to 2014, afta di tech company crisis. Afta e retire from Microsoft, Ballmer den buy Los Angeles Clippers basketball team, wey don increase for value for recent years. Today, na di fifth most valuable team for di American league, di NBA.

9. Mukesh Ambani (India)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (10)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $116 billion

Ambani fortune don grow significantly thanks to di appreciation of shares of im conglomerate, Reliance Industries. Di company dey operate for di petrochemical, oil and gas, telecommunications, retail and financial services industries.

10. Larry Page (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (11)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $114 billion

Co-founder and member of di board of directors of Alphabet, di parent company of Google, e remain, wit Sergey Brin, di main shareholder of di technology giant.

11. Sergey Brin (Russia/United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (12)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $110 billion

Co-founder and board member of Alphabet. Brin bin resign as chairman of di company for December 2019, but remain di majority shareholder alongside Larry Page.

12. Michael Bloomberg (United States)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (13)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $106 billion

Co-founder of di financial information and media company Bloomberg LP, e currently own 88% of am. E bin serve as mayor of New York City for 12 years.

13. Amancio Ortega (Spain)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (14)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $103 billion

Im fortune bin rise last year thanks to one 43% rise for shares of im clothing company, Inditex, wey dey run di Zara chain. Im real estate portfolio include logistics, residential and office properties, mainly for Europe and di United States.

14. Carlos Slim (Mexico)

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (15)

Wia dis foto come from, Getty Images

Net worth: $102 billion

Di businessman den na richest pesin for di world and remain di richest for Latin America. Im fortunes bin grow last year thanks to di appreciation of di Mexican peso and one 60% rise for di share price of im industrial conglomerate, Grupo Carso. Slim and im family control América Móvil, di largest mobile telecommunications company for Latin America.

One club wey dey grow

For di past 10 years, di wealth of club members don increase by 255%, far more dan di average billionaire.

Since most fortunes dey invested for financial markets, di value of dis assets constantly dey change.

Dis na how Bill Gates bin briefly reache di “hundred billion” mark for 1999, bifor im fortune almost half during di tech company crisis.

No one bin manage to break dat record again for almost two decades, even wen markets bin dey make lot of moni, just bifor di Great Recession of 2008-2009.

Di tori kontinu like dis until Jeff Bezos cross di limit again for 2017, to become di second member of di $100 billion tycoon club thanks to di dramatic rise for Amazon stock value.

No be until 2021 wey Bezos bin no longer dey alone for di top, wen Elon Musk, Bernard Arnault and Bill Gates join am.

Today, wit di rise of mega-wealth around di world, e dey increasingly common to join dis club.

Richest billionaires: Bernard Arnault, Elon Musk, Mark Zuckerberg, who be di members of di 100 billion dollar club? - BBC News Pidgin (2024)
Top Articles
Latest Posts
Article information

Author: Dr. Pierre Goyette

Last Updated:

Views: 5630

Rating: 5 / 5 (50 voted)

Reviews: 81% of readers found this page helpful

Author information

Name: Dr. Pierre Goyette

Birthday: 1998-01-29

Address: Apt. 611 3357 Yong Plain, West Audra, IL 70053

Phone: +5819954278378

Job: Construction Director

Hobby: Embroidery, Creative writing, Shopping, Driving, Stand-up comedy, Coffee roasting, Scrapbooking

Introduction: My name is Dr. Pierre Goyette, I am a enchanting, powerful, jolly, rich, graceful, colorful, zany person who loves writing and wants to share my knowledge and understanding with you.